For some time now, pipo wey come from Kogi West Don tell INEC say Dem don tire for one ogbonge oga senator wey him name Na Senator Dino Melaye.
This gbege don dey ground since, sake of say the senator and the Governor get small kwanta and dem no dey agree.
Remember say Oga senator Don first deny say Kogi west Pipo no give am notice say Dem no like the way wey him dey do him things for the Senate House. And later him come go court say make Dem stop INEC from the arrangement, but yesterday nai court tell INEC make Dem continue to send am back to him house.
One INEC oga tell us yesterday say Dem go soon bring timetable come out to show pipo how dem go do the arrangement pass.
We go give una more infomate as Dem dey come for dis Mata!

No comments:
Post a Comment