Tori enter our hand today say Army Dem don surround the house wey belong to IPOB oga wey him name Na Nnamdi Kanu.
This one happen after Dem be deny say dem no go near he house day before yesterday.
Remember say Dem IPOB people be share one video like that wey show how Army Dem shoot one person.
Another Tori be say the soja Dem still go NUJ office wey dey Aba road for Abia state go scatter and spoil Dem office and things wey Dem take dey work.
The soja Dem say the reason wey make Dem do am be say Dem see one person dey video Dem when Dem dey pass!
More Tori dey come...

No comments:
Post a Comment